Decision
Ursula Nafula
Vusi Malindi

My village been get many problems. We been dey always get long line to fetch water from one tap.

1

We been de always wait food wey people go dash us.

2

We been de always lock our house on time because of thief.

3

Many children stop to de go school.

4

Small small girls begin de work as house girl for oda villages dem.

5

Small small boys just de waka upandan for inside village while some odas dey work for pipo farm.

6

If wind blow small laikdis, na so paper wey pipo troway go hang for on top tree and fence dem.

7

Pipo go just dey wound anyhow from di glass wey pipo troway anyhow.

8

NA so one day, tap water come dry and notin dey inside our containers.

9

My papa comot go house to house dey tell pipo say make dem attend village meeting.

10

Pipo gada under one big tree put ear for ground de hear.

11

My papa stand up talk say, "We need to join our hand work togeda solve dis our problem o."

12

Juma wey be eight years old, siddon for one tree shout talk say, "I go fit help o, I go dey clean all di dorti."

13

One woman com say, "Di women go join me to dey plant food."

14

Anoda man stand up talk say, "Di men go dig well."

15

Na so all of us com shout wit one voice say, "We must to change our own lives." From dat day we com work togeda to solve our problems by oursef."

16
You are free to download, copy, translate or adapt this story and use the illustrations as long as you attribute in the following way:
Decision
Author - Ursula Nafula
Translation - Mimi Werna
Illustration - Vusi Malindi
Language - Pidgin English (Nigeria)
Level - First paragraphs