Di moon and di cap
Noni
Angie & Upesh

All of us go di fun fair.

1

Papa buy my broda fine eyeglass. Mama buy me blue cap wey dey shine.

2

As we de go house, strong wind come blow. E blow my cap comot.

3

My cap com hang on top branch of one big tree.

4

I cry well, well. Na so I no com eat my night food.

5

Di moon com comot later for night. E begin look my cap wey hang for di big

6

Di moon wear my cap. E sweet am sotay e com de smile. Me sef com smile.

7

8

9

You tink say sun need to de wear cap?

10

You fit guess di cap wey I wear today?

11
You are free to download, copy, translate or adapt this story and use the illustrations as long as you attribute in the following way:
Di moon and di cap
Author - Noni
Translation - Mimi Werna
Illustration - Angie & Upesh
Language - Pidgin English (Nigeria)
Level - First words