Sun wey busy well, well
Mimi Werna
Joe Werna

Di sun comot for morning for east.

I hear as cock dey shout kukuruku when day break.

1

Di sun com waka pass Terfa compound before morning food.

I hear di scent of di bier and akpupa wey follow di sun com my window.

2

When time reach to chop for afternoon di sun waka go behind di tree wey dey school.

E come go meet the potoh-potoh wey dey for di middle of di playground.

3

Di sun stand for up, my shadow follow am stand.

Me and my friends com dey play wit our shadow.

4

My shadow com grow big, e com small. We run pursue am.

My shadow com long, com short. We run pursue am.

5

I com stand with my friends. Our shadow com dey shake one kain.

We com tire com go back class. When school close we com go house.

6

Di sun com dey yawn.

I see as di sun dey sink slowly for west. I see my shadow for on top wall.

Time don reach to go lie down.

7

The sun go lie down for inside cloud.

As I lie down for bed, I com dey dream of how di sun dey take travel.

8
You are free to download, copy, translate or adapt this story and use the illustrations as long as you attribute in the following way:
Sun wey busy well, well
Author - Mimi Werna
Translation - Mimi Werna
Illustration - Joe Werna
Language - Pidgin English (Nigeria)
Level - First sentences